Saturday, January 12, 2008

'EFCC Court By Adesina Ogunlana

Vol 7 No 21 12th March 2007

THE LEARNED SQUIB


Mr. Lawyer, make I

tell you,
You no fit deceive
me,
Me, I no know
book but commonsense
I get,

When we first saw
No be so, so mouth
Una dey make?
Una say when we
get to court
Tori go change?

Which court?

Which tori don
change now?
Make I tell you,
Tori don hard pass

Dis court dey
carry man come

Dis one na court?

Di court wey I
know
Both accused and
proseku
Na equal 50-50

chance
Efri tin depend on

how you
Play your card.

I say did court na

court so?
Court where

Accused don guilty
From day one
Court wey

prosecution go dey
fumble
Mess well, well
And yet win,

Well well
Dat one na court?
Court where

Constitution
Na mere akara

paper
Dat one na court?
Court where law

no count
Dat one na court?

Court where

accused persons
Win only by

Accident
Dat one na court?


EFCC court,
Paddyman, dat
one no be court
Abeg,
Na slaughter
house e be.

No comments: